Thursday, 25 September 2014

LAW STUDENTS SHAKARA FOR THEIR CULTURAL PRIDE DAY.


Omo mehn, nor be small thing oo!  *my eyes dey chook* na so gist carry Aproko land for main auditorium yesterday as Law students (set 2014) just dey  denge-denge waka reach main auditorium for where all the correct owamnbe things dey shele ,to celebrate their cultural pride day. Come see repping....*mtcheew* make sense die!
Aproko snap all the pictures before dem enter main auditorium and even the ones wey snap for corridor sef *lwkmd*.The guys sef con scarce na so babes just dey pose for camera...abegi...who no like paparrazi! no dulling abeg...anyways congratulobia to them!..Oya see all the pictures.....na fashion parade thinz!
 .







































 








Thursday, 18 September 2014

CFC dey host Academic Summit





The Communicators for Christ Fellowship wey dey inside Mass Communication dey do dia annual Academic Summit and e go hold for Maid Auditorium tomorrow. Aproko gather sey e go be their biggest event so far and ogbonge media ogas go land dia sef.As their poster dey informate, Dan Foster go waka come,Tolu Ogunlesi for Punch Newspaper,d bros wey win CNN African Journalist of the year go iyanga come, Mr. Declan Ok[palaeke, Oga and Madam at the top for Mass Communication department, Prof. Ralph Akinfeleye and Dr. Abigail Ogwezzy sef go reach main auditorium and some other ogbonge guests sef go land Unilag tommorow.

Sodeinde Hall Week 2014


As una know Unilag normal parole on a yearly basis, na Sodeinde Hall week be de next to do their own o!.Moremi Hall don first scatter ground, their deir hall week make sense die! ome eh, doz babes grab money nor be small.Na so dem hire Shina Rambo and him guy, Jaywon chook eye enter there and other young artiste wey make sense too.
Anyways, Sodeinde hall week go end on Friday and i hear sey na de first hall wey go organise VIP things plus movie night and awoof brekete! trust Makama babes na, mtschew!! dem go chance everybody for dia..