Wednesday, 15 October 2014

#LagosHornFreeDay!



Hmm..! all the publicity wey dem dey carry on top dis horn free day sef na  wa..Isay make I waka enter road go do operation inspection on top dis matter.I waka from oshodi, Bariga and Yaba back to back today and laugh just dey turn my belle.The idea of horn free day na to reduce noise pollution and to encourage road discipline.For Oshodi, I notice small change except for the agboro guys wey dey make noise anyhow like say na dem get road, Bariga na another wahala on its own and the only 'horn makers' na  the okada riders wey dey blow their horns anyhow infact i no even think say anybody know the meaning of horn free day.Infact them blow horn like no man business...one bariga bus almost knock person down na so him blow horn as fear of say him almost kill person. Some Nigerian drivers na goat!*laughing in pidgin*.Omo Yaba na frustration things na hold up cripple them for road...mehn see swerving! u go fear horning naa...i nosure say Lagos drivers no blow horn today!